
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, 8.8 magnitude earthquake strike off Russia Kamchatka Peninsula on Wednesday
5 hours wey don pass
Authorities don begin evacuate pipo for Japan, Hawaii and some parts of di US West Coast as magnitude 8.8 earthquake off Russia far eastern Kamchatka Peninsula bin trigger tsunami warnings across di Pacific Ocean.
Dem report Tsunami waves wey dey as high as 3-4 metres (10-13 feet) for Kamchatka while 30cm (12in) waves don hit one city for Hokkaido, northern Japan.
Hawaii Govnor Josh Green don ask pipo to follow evacuation orders and stay calm while US President Donald Trump advise Americans to dey on alert for tsunami warnings.
Several pipo don injure for Kamchatka sake of di earthquake and strong aftershocks dey expected, TASS news agency report.
Authorities don also issue different Tsunami alerts for parts of China, di Philippines, Indonesia, Guam, Peru and di Galapagos Islands off Ecuador.
Japanese authorities ask nearly 2 million pipo to evacuate
Japanese authorities don ask more dan 1.9 million pipo to evacuate. Around 10,500 of dis pipo dey for Hokkaido, wia local media footage show pipo dey gada ontop rooftop.
Some pipo also gada for one observatory wey overlook di beach for Chiba south of Tokyo.
Authorities don continue to urge residents on Japan east coast to evacuate to higher ground.
Dozens of waves don dey observed across Japan Pacific coast. Evacuation warnings don span hundreds of kilometres/miles along im pacific coast – from Hokkaido for di north to Wakayama prefecture for di south.
Di Meteorological agency say tsunami waves fit reach up to 3 metres high.
Meanwhile, Russia Sakhalin region don declare a state of emergency for di northern Kuril Islands, di same part of di kontri wia video of tsunami waves for port town bin emerge.
Mayor Alexander Ovsyannikov say “evrione” for dat area don dey evacuated. “Enough time bin dey, a whole hour. So evrione bin dey evacuated, all di pipo dey for di tsunami safety zone,” e tok, AFP report.
Tori be say Tsunami waves hit California around 1am dis morning. Oda cities wey report say dem see di waves include Seattle, Monterey, and Eureka, California.
Department of Transportation for Hawaii say dem don cancel all flights to and from Kahului Airport, di main airport for Maui.
For social media post, dem say passengers dey take shelter for di airport terminal.
For early July five powerful earthquakes of 7.4 magnitude hit ocean water near Kamchatka. Di quake get di largest depth of 20 kilometre according to tori pipo AP.
Wetin be tsunami?
Tsunami na veri strong long waves wey dey suddenly come from ocean. E dey usually happun wen earthquake don happun below or under ocean.
E dey take long hours to land for any location e wan happun. Dis dey give authorities enough time to issue warnings and to evacuate residents ahead.
E no be like normal ocean waves. Tsunamis no dey only show for surface level, e dey start from under di ground water and dey move wit high energy and force – e fit cause major damage on anytin e hit.