Canada Police logo and title

Wia dis foto come from, Getty Images /NurPhoto

Wetin we call dis foto, Royal Canadian Mounted Police

one hour wey don pass

Read am in 3 mins

Police for Canada don confirm say at least 10 pipo don die afta one female shooter open fire for one high school for western Canada on Tuesday.

Royal Canadian Mounted Police say di shooter dey among pipo wey die, say di injury she get dey like na ‘self inflicted’ injury.

About 25 pipo dey collect treatment for injury dem get from di incident.

Dem find six pipo dead for inside di high school wey dey for di town of Tumbler Ridge for British Columbia.

Kontinu to dey read

Dem also find two pipo for one compound wey near di place of di shooting and one oda pesin die on di way to hospital.

Police statement neva tok how many of di victims be minors.

Police know identity of di shooter

Officials say dem know di identity of di shooter but dem neva release am. Dem neva release di shooter identity or di gender, dem only describe di shooter as “female wey wear dress and brown hair”.

Dem Neva also identify di kain gun she use do di attack, and dem neva release di ages of di victims wey die.

Canada Prime Minister Mark Carney say “I dey devastated by di shooting and im govment dey stand wit di British Columbians as dem dey confront dis horrible tragedy”.

E cancel im planned trip to Munich Security Conference sake of di incident.

History of shooting for Canada

Di shooting na one of di deadliest shootings for history of Canada.

For 2020 gunman wey pose as police officer kill 22 pipo for Nova Scotia axis of di kontri.

For 1989 dem kill 14 women for one anti feminist attack for L’Ecole Polytechnque University for Montreal.

Tumbler Ridge Secondary School get about 160 students wey dey between 12 to 18 according to di school website. Authorities don shutdown di school for di rest of di week and dey give counseling to dose wey need am.

Tumbler Ridge na remote area wit population of about 2400 pipo for western Canada.