Liver, beef, raisins, keshew, buckwheat, spinach, tomatoes, potatoes, dark chocolate, pumpkin seeds, lentil, broccoli.

Wetin we call dis foto, Food wey dey high in iron

Published 8 hours wey don pass

Read am in 4 mins

Wen e come to make your body absorb iron, no be only di food wey you dey chop matter, but also di way wey you dey chop am.

As e be say about one in evri three pipo get iron deficiency, e good make we understand say no be only wetin we dey chop matter. Di way wey we prepare our food and how we take chop am fit help our body absorb enough iron wey e need.

Iron deficiency na di most common nutrition problem for di world, especially among children and women wey dey dia child-bearing age.

To dey feel tired, weak or like say your breath dey cut, fit be sign say your body no get enough iron. Na becos dis important mineral dey help your body produce haemoglobin, di protein wey dey carry oxygen go almost evri part of di body.

“E better make pesin prevent anaemia by eating correct and balanced food,” according to Susan Fairweather-Tait, professor of mineral metabolism for University of East Anglia.

But wen e come to how well our body dey absorb iron from food, no be all iron-rich foods dey work di same way. Some foods dey wey dey help di body absorb iron better pass odas.

Vegetable

Na two dietary forms of iron dey. Dem dey see Heme iron for meat and seafood, while non-heme come from plant-based foods.

Our body dey absorb heme iron wey come from animal foods more easily dan non-heme iron wey dey plant foods.

Body fit absorb about 15% to 30% of heme iron, but for non-heme iron, di amount wey body fit absorb dey much lower, about 2% from dried beans and oda legumes, and around 7% to 9% from green leafy vegetables.

As food price dey rise and more pipo dey worry about di effect of red meat on health and di environment, some pipo don reduce di amount of red meat wey dem dey chop. According to Yemisi Latunde-Dada, senior lecturer for nutritional sciences for King’s College London, dis fit increase di risk of iron deficiency if pipo no replace am wit oda foods wey get enough iron.

Thankfully, many plant-based sources of iron dey wey fit make your daily goal.

Although body no dey absorb iron from plant foods easily, many ways dey wey pesin fit use make di body take in more iron from these foods.

1. Boil some greens, steam odas

Spinach – get compounds wey dem dey call oxalates. These fit bind to iron and block how much our bodies take up. But wen we boil am, e dey release di compounds and body fit absorb more iron.

Dis rule dey only apply to leafy greens wey dey high in oxalates, like spinach, Swiss chard and beetroot leaves.

Oda greens, like lettuce, cabbage and bok choy, no need make dem boil out dia oxalates. In fact, eating dem raw or steam go help retain more vitamin C, and provide iron-absorption boost.

2. Pair iron-rich food with vitamin C

Research don show wen we add vitamin C to our diet, we dey absorb more iron.

“Vitamin C na potent enhancer of iron absorption from plant food sources,” Latunde-Dada tok.

Alongside foods wey contain iron, you fit try squeeze lemon on drink glass of orange juice wit your breakfast.

3. Embrace di ferment

Fermentation fit also help your body absorb more iron. Dat na becos e dey break down phytic acid, one naturally occurring compound dem dey see for grains, nuts and seeds, wey dey make am hard for di body to take up iron from food.

4. No rely only on fortified food

Many staple foods wey include breads and breakfast cereals dey fortified wit iron.

But manufacturers dey usually use types of iron wey body no dey absorb easily becos dem no dey change di food taste, colour or how long e fit stay bifor e spoil.

For inside one study wey dey measure iron absorption from fortified foods, researchers see say iron absorption from infant cereals dey very low, wey range from 0.6 to 2.2%.

In contrast, di same study discover say iron absorption dey higher for bread rolls made wit refined white flour.

Anoda study find say absorption from bread made wit refined flour reached 13.6%.

5. Watch wetin you drink wit your food

What we drink whilst eating can also affect how much iron we absorb from our diet.

Like oxalates, dem fit reduce iron absorption by compounds like polyphenols, tannins, fibre and phytates, Latunde-Dada tok.

Coffee and tea contain tannins and polyphenols, wey mean say if we dey chop iron-rich breakfast cereal plus beer, e no dey go down well.

If you want a cup of tea, e dey best to drink am at least two hours afta you chop, Fairweather-Tait advice.