
Wia dis foto come from, Peter Joneleit/Getty Images
11 March 2026, 13:13 WAT
New Informate one hour wey don pass
Read am in 4 mins
Bam Adebayo score 83 points to become di second highest number for NBA game afta Miami Heat beat di Washington Wizards 150-129.
Dis na veri high record for di history of di National Basketball Association (NBA) since 2006.
Di Miami Heat star Bam Adebayo produce di second highest single game scoring for NBA history, to overthrow Kobe Bryant wey score 81 points for 2006.
Di 28-year-old centre dey just 17 points behind Wilt Chamberlain 100-point outing wey dey stand as di highest record since March 2, 1962.
Kontinu to dey read
Adebayo score 36 of 43 free-throws – records for di most free-throws attempt and most free-throws for Kaseya Center in Miami.
“Na Wilt, me, den Kobe, dat sound crazy,” e tok.
Bam Adebayo describe di outing as “special moment” and say e get “really emotional” wen e realise di scale of im achievement.
To score 83 points for single game na record wey no dey common for basketball but dis record by Bam Adebayo don challenge many tins for im career.
E pay tribute to im family and trainers wey e say ‘dem don see am at di lowest, at di bottom of di bottom, and to get dis moment dey pretty emotional.’
No doubt say wit di name Adebayo, na pesin wey get Nigerian root and dat one don totori several basketball lovers for Naija.
Record wey Bam Adebayo break
Bam Adebayo set Miami Heat records for di highest-scoring game and di highest-scoring quarter.
Di old club mark for game na 61 points for 2014 by LeBron James.
Adebayo shoot 20-for-43 from di floor, 7-for-22 from 3-point range and 36-for-43 at di free-throw line. E also grab nine rebounds.
Abebayo also set NBA single-game records for most free throws and most free-throw attempts.
Chamberlain and Adrian Dantley na di former record-holders for foul shots, wit 28 each.
By di end of di first quarter, Bam get 31 points to top LeBron James 25 points record wey e do two times.
Bam become di sixth player for NBA to score 30 for quarter since NBA play-by-play dey available since 1996.
E be di first player for NBA history to make 25 free throws and five 3-pointers for a game.
Profile of Bam Adebayo
Bam Adebayo dey play im international basketball for Team USA, but e get close connection to Nigeria through im father.
Im mama Marilyn Blount bin move from New Jersey to North Carolina wen e be seven years wey make di parents live apart. But Bam still embrace im Nigerian father name.
Dem born Bam Adebayo for 1997 to a Nigerian Yoruba father John Adebayo, and African American mother.
Im full name na Edrice Femi Adebayo but dem give am di nickname “Bam,” at di age of one. E attend Northside High School for Pinetown, NC.
E bin attend di University of Kentucky for one season (2016 to 2017) and become Kentucky player to start all 38 games for 2016 to 2017.
For 2023, Bam Adebayo reach NBA Finals wit Miami, and don play seven NBA seasons wit Miami.
E be three-time NBA All-Star (2020, 2023, 2024), one-time NBA All-Defensive First Team (2024) and four-time NBA All-Defensive Second Team (2020-23).
E be member of di 2020 U.S. Olympic Men Basketball Team wey get di 5-1 record to capture fourth-straight Olympic gold medal for Tokyo.