
Wia dis foto come from, Spencer Platt/Getty Images
23 March 2026, 14:10 WAT
New Informate 26 minutes wey don pass
Read am in 1 mins
Two pilots don kpai afta one Air Canada plane jam firefighting vehicle for LaGuardia Airport for New York
Di plane, wey bin carry 72 passengers and four crew, bin initially land safely from Montreal on Sunday evening.
According to CBS News, di BBC US partner, di Air Canada plane bin land afta e arrive from Montreal bifor e slow and collide wit a vehicle.
Dem don take 41 passengers and crew to hospital – dem don discharge all of dem except nine pipo. Two fire truck officers dey for stable condition for hospital.
Kontinu to dey read
Di airport, wey be one of di busiest for di US, dey expected to remain closed until at least 14:00 ET (18:00 GMT).
Di New York City Fire Department tell pipo say make dem “expect cancellations, road closures, traffic delays and emergency personnel near LaGuardia Airport”.