Donald Trump sitting and smiling

Wia dis foto come from, Andrew Harnik/Getty Images

15 minutes wey don pass

Di Trump administration dey offer unaccompanied migrant children $2,500 to voluntarily comot from di United States, according to one letter wey dem send to migrant shelters, wey Reuters see.

Officials for di Department of Homeland Security’s Immigration and Customs Enforcement confam say monetary offer dey ground but e no specify di amount, Reuters report.

Di move na di latest financial wey di DHS dey make under President Donald Trump – wey aim to encourage voluntary deportations.

For June, di State Department bin move $250 million to DHS for voluntary deportations wit di administration offering a $1,000 stipend to migrants wey “deport diasefs”.

According to di letter sent to shelters on Friday by di DHS Office of Refugee Resettlement, di department go provide “one-time resettlement support stipend of $2,500” to unaccompanied children 14 or older.