{"id":312507,"date":"2025-11-25T09:48:09","date_gmt":"2025-11-25T09:48:09","guid":{"rendered":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/312507\/"},"modified":"2025-11-25T09:48:09","modified_gmt":"2025-11-25T09:48:09","slug":"why-us-label-cartel-de-los-soles-a-terrorist-organization-who-dem-be","status":"publish","type":"post","link":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/312507\/","title":{"rendered":"Why US label Cartel de los Soles a terrorist organization &#8211; Who dem be?"},"content":{"rendered":"<p><img fetchpriority=\"high\" decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-content\/uploads\/2025\/11\/69271a70-8a81-11f0-b4ed-15140726731b.jpg.webp.webp\"   alt=\"Members of di Venezuelan Army wear uniforms and red berets.\" loading=\"eager\" width=\"930\" height=\"523\" style=\"aspect-ratio:930 \/ 523\" class=\"css-4ejld5\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, Getty Images<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, Di US tok say na members of Venezuela military dey lead di cartel but Venezuela govment don dismiss di allegations as a &#8216;ridiculous lie&#8217;Article Information25 November 2025, 10:23 WAT<\/p>\n<p>New Informate one minute wey don pass<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Di United States don designate di Cartel de los Soles (Spanish for Cartel of di Suns) as a foreign terrorist organisation.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">US allege say na Venezuela president, Nicol\u00e1s Maduro, plus senior figures for im govment dey head di group.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">To label an organisation as a terrorist group give US law enforcement and military agencies broader powers to target and dismantle am.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">In recent months, US don dey put pressure on Maduro, as dem say im govment dey illegitimate following last year election, wey many pipo say dey rigged.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Di designation give am anoda way to turn up di heat.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">But questions don rise as to weda Cartel de los Soles actually exist. However, Venezuela foreign ministry don &#8220;categorically, firmly, and absolutely reject&#8221; di designation, wey e describe as a &#8220;new and ridiculous lie&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Venezuela interior and justice minister, Diosdado Cabello, for long don call am &#8220;invention&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Cabello, wey dey alleged to be one of di high-ranking members of di cartel, don accuse US officials say dem dey use excuse target pipo dem no like.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">&#8220;Whenever pesin bother dem, dem go name di pesin as di head of di Cartel de los Soles,&#8221; e tok for August.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Gustavo Petro, di left-wing president of Venezuela neighbour, Colombia, don also deny di cartel existence.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">&#8220;Na di fictional excuse of di far right to bring down govments wey no dey obey dem,&#8221; e write on X for August.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">But di US state department no gree, dem say di Cartel de los Soles no only exist but e don &#8220;corrupt Venezuela military, intelligence, legislature, and judiciary&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Experts wey di BBC follow tok say di truth lie for somewhere in between.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-content\/uploads\/2025\/11\/64c84a70-8a50-11f0-94f4-77b666520245.jpg.webp.webp\"   alt=\"Nicol\u00e1s Maduro, President of Venezuela, for one meeting for di Miraflores Palace for Caracas on 9 July 2019.\" loading=\"lazy\" width=\"1024\" height=\"576\" style=\"aspect-ratio:1024 \/ 576\" class=\"css-4ejld5\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, Getty Images<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, Di US govment allege say Nicol\u00e1s Maduro dey lead di Cartel de los Soles<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Di term Cartel de los Soles first come out for di early 1990s.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Na di Venezuelan media coin am afta di drug-trafficking allegations against one general wey dey in charge of counter-narcotic operations for Venezuela National Guard and dem refer to di sun-shaped badge wey generals dey wear on dia epaulettes to indicate dia rank.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Mike LaSusa, one expert for organised crime for di Americas wey be deputy content director for Insight Crime, tok say Venezuelan officials wit alleged links to drug trafficking begin dey use di moniker, regardless of weda dos officials dey part of di same organisation.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-content\/uploads\/2025\/11\/870f78c0-8a45-11f0-b13a-e74276113474.jpg.webp.webp\"   alt=\"Venezuelan Defence Minister Vladimir Padrino L\u00f3pez (centre) hold one press conference for Caracas wit army generals in support of Nicol\u00e1s Maduro on 24 January 2019.\" loading=\"lazy\" width=\"4928\" height=\"2772\" style=\"aspect-ratio:4928 \/ 2772\" class=\"css-4ejld5\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, Getty Images<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, Di name &#8220;soles&#8221; (suns) come from di sun-shaped badge wey Venezuelan generals dey wear on dia uniforms.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Ra\u00fal Ben\u00edtez-Manau, one organised crime expert from Mexico UNAM university, tok say di group activities start for di late 1980s and early 1990s in response to developments for neighbouring Colombia, di world largest producer of cocaine.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">At di time, dem dey dismantle di powerful Medellin Cartel, wey based in di Columbian city wit di same name, and one major counter-narcotics offensive for di  country dey bear fruit.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">As established smuggling routes bin come under pressure, Mr Ben\u00edtez-Manau argue say, di Cartel de los Soles start to dey provide alternative ways to transport cocaine from Colombia.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Dem grow strong during di early years of di presidency of Hugo Ch\u00e1vez, di left-wing president wey lead Venezuela from 1999 to im death for 2013, e tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">&#8220;Ch\u00e1vez like to challenge di United States and cut all military co-operation ties between di Venezuelan army and di US,&#8221; e explain.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Without di oversight of di US Drug Enforcement Administration (DEA), &#8220;some [Venezuelan] army officers feel free to do business wit criminals&#8221;, Mr Ben\u00edtez-Manau tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Facing military pressure at home, di guerrilla group bin move some operations go Venezuela, safe in di knowledge say Venezuelan president &#8220;see dem as leftist ideological allies&#8221;, Mr Ben\u00edtez-Manau explain.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Wesley Tabor, one former DEA agent wey work for Venezuela, tok say di Farc no only find &#8220;a safe haven for Venezuela&#8221; but also many govment officials, &#8220;from street-level police to di military aviation&#8221;, soon bicom dia partners in drug trafficking.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Togeda, dem &#8220;begin flood di US wit hundreds of tonnes of cocaine&#8221;, e tok.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-content\/uploads\/2025\/11\/049099f0-8a69-11f0-84c8-99de564f0440.jpg.webp.webp\"   alt=\"Former Venezuelan intelligence Chief Hugo Carvajal during im extradition hearing to di United States for Madrid, 2019.\" loading=\"lazy\" width=\"2000\" height=\"1333\" style=\"aspect-ratio:2000 \/ 1333\" class=\"css-4ejld5\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, Reuters<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, Former intelligence Chief Hugo Carvajal plead guilty to drug trafficking and narco-terrorism charges for US<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Di Cartel de los Soles, different from oda drug networks bicos e lack a formal structure, Mr LaSusa tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">No be group per se, e tok, but rather &#8220;a system of widespread corruption&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">E add say di economic crisis wey dey face Venezuela under President Ch\u00e1vez successor for office, Nicol\u00e1s Maduro dey ginger di group.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">&#8220;Di Maduro regime no fit offer security forces decent salary and, to keep dia loyalty, e allow dem to accept bribes from drug traffickers,&#8221; Mr LaSusa explain.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Mid- and lower-ranking officers wey dey control Venezuela key entry and exit points, like di airports, make up di Cartel de los Soles, Mr Ben\u00edtez-Manau tok, as dem dey for di right position to facilitate di flow of drugs.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">But US officials dey adamant say di tentacles of di Cartel de los Soles reach to di highest levels of di Maduro govment, including di president imself.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">For 2020, di US justice department accuse Maduro and 14 odas say dem collabo wit armed Colombian groups to ship cocaine go United States.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Among di high-ranking officials dem mention na; Defence Minister Vladimir Padrino and di former head of Venezuela Supreme Court, Maikel Moreno.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">For di charges, US prosecutors also allege say since at least 1999, Maduro, Interior Minister Diosdado Cabello, former military intelligence chief Hugo Carvajal, and former General Cl\u00edver Alcal\u00e1 dey lead di cartel.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Dem say information wey former high-ranking Venezuelan military officials \u2013 wey include Carvajal and Alcal\u00e1 \u2013 provide back dis up.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Leamsy Salazar, one former security chief for di late Hugo Ch\u00e1vez, provide US officials wit information about di Cartel de los Soles for as early as 2014.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Salazar, wey don comot Venezuela wit di help of di DEA, tok say Interior Minister Cabello na di leader of Cartel de los Soles.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Cabello deny di allegation, e argue say di accuse na part of one &#8220;international conspiracy&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">But di accusations from former Venezuelan officials continue.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">For 2020, Gen Alcal\u00e1 bin hand ova imsef to DEA agents afta e fall out wit di Maduro govment, and e plead guilty to providing support to di Farc plus dia cocaine-trafficking operations.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Earlier dis year, former Venezuelan spymaster Carvajal \u2013 wey also run comot Venezuela afta e disagree wit Maduro &#8211; plead guilty for one US court, as well, to charges of drug-trafficking and narco-terrorism.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">&#8220;Ova di years, im and oda officials for di Cartel de los Soles bin use cocaine as weapon, dem flood New York plus oda US cities wit poison,&#8221; one federal prosecutor tok about Carvajal, known as &#8220;El Pollo&#8221; (The Chicken), during di trial.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-content\/uploads\/2025\/11\/31685750-8a6f-11f0-8ba8-9d1af6a803b3.jpg.webp.webp\"   alt=\"One man waka pass one banner offering rewards for information wey go lead to di arrest of Venezuelan President Nicol\u00e1s Maduro and Interior Minister Diosdado Cabello for Villa del Rosario, Norte de Santander, Colombia.\" loading=\"lazy\" width=\"1024\" height=\"576\" style=\"aspect-ratio:1024 \/ 576\" class=\"css-4ejld5\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, Getty Images<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, US dey offer reward for information wey go lead to di arrest of President Maduro and Interior Minister Diosdado Cabello<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">Maduro and Interior Minister Cabello remain for Venezuela but di US recently increase dia rewards for information wey go lead to dia capture to $50m (\u00a338m) and $25m respectively.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">BBC contact Venezuelan govment for comment on US allegations but dem no receive response bifor publication.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">However, di Maduro govment for long don dismiss di drug-trafficking accusations wey di US govment level against dem as attempt by di US to justify exiling Maduro.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">For one statement released on Monday, 24 November, di Venezuelan foreign ministry call di designation of di Cartel de los Soles as a terrorist organisation &#8220;a ridiculous fabrication&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-1umsmdl e17g058b0\">E insist say Cartel de los Soles &#8220;no dey exist&#8221; plus say di move na &#8220;horrible lie to justify illegitimate and illegal intervention against Venezuela&#8221;.<\/p>\n","protected":false},"excerpt":{"rendered":"Wia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Di US tok say na members&hellip;\n","protected":false},"author":2,"featured_media":312508,"comment_status":"","ping_status":"","sticky":false,"template":"","format":"standard","meta":{"footnotes":""},"categories":[18],"tags":[23,3,21,19,22,20,25,24],"class_list":["post-312507","post","type-post","status-publish","format-standard","has-post-thumbnail","category-united-states","tag-america","tag-news","tag-united-states","tag-united-states-of-america","tag-unitedstates","tag-unitedstatesofamerica","tag-us","tag-usa"],"_links":{"self":[{"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/posts\/312507","targetHints":{"allow":["GET"]}}],"collection":[{"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/posts"}],"about":[{"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/types\/post"}],"author":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/users\/2"}],"replies":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/comments?post=312507"}],"version-history":[{"count":0,"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/posts\/312507\/revisions"}],"wp:featuredmedia":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/media\/312508"}],"wp:attachment":[{"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/media?parent=312507"}],"wp:term":[{"taxonomy":"category","embeddable":true,"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/categories?post=312507"},{"taxonomy":"post_tag","embeddable":true,"href":"https:\/\/www.newsbeep.com\/us\/wp-json\/wp\/v2\/tags?post=312507"}],"curies":[{"name":"wp","href":"https:\/\/api.w.org\/{rel}","templated":true}]}}